Chrisland school girl viral video: Lagos state DSVA, ministry of education and odas dey investigate alleged sexual violence involving minors afta dem shut down school

C

Lagos state Ministry of Education, Office of Education Quality Assurance, Ministry of Youth and Social Development, Ministry of Justice and di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency dey investigate one case involving students of Chrisland school wey happun for Dubai, United Arab Emirates.

Lagos state make di announcement on Monday as dem also announce di shutting down of di schools.

For statement wey di Lagos state Domestic and Sexual Violence Response Agency (DSVRA) bring out, dem say di “alleged sexual violence case” wey involve minors – underaged students dey under investigation while di criminal allegations don dey escalated to di Commissioner of Police

How to know say dem dey bully your pikin for school
Mama of 14-year-old Keren Akphager wey die want justice say dem allegedly rape her for boarding school
Thousands of Nigerians sign petition on Sylvester Oromoni death
“Di attention of Lagos state goment don dey draw to di alleged sexual violence case involving students of Chrisland School wey happun for Dubai, United Arab Emirates,” di statement tok.

Popular Music Artist Manager, Ubi Franklin na im first Tweet about di mata on Sunday, 17 April, 2022 but e bin no mention di name of any school.

Dis Tweet come generate massive reactions from Nigerian Tweeter users wey come make am trend all ova social media.

DSVRA say in view of di allegation, dem dey committed to make sure say adequate medical and pscyho social support dey provided to those involved.

“Dis na to reassure members of di public of di State goment commitment to safety and child protection, especially to make sure say all child-cantered institutions within di state, formulate and implement policies and systems wey be complaint with di Executive Order (NO.EO/AA08 of 2016), Lagos State Safeguarding and Child Protection program.”

DSVRA warn about sharing sexual explicit video wey involve children
DSVRA also use dis medium to remind di general public of di implications concerning sharing sexual explicit video wey involve children.

“We also use dis medium to remind di general public of di implications pertaining to engage in any visual depiction of sexual explicit involving of a child commit offence and dis dey liable to custodial sentence of fourteen (14) years.”

Dis include producing, distributing, receiving, or processing an image of child pornography.

“In di meantime, all Chrisland schools within Lagos state don dey hereby closed pending further investigation.”

Meanwhile, one woman wey say she be di mama of di pikin wey dey involve for di mata say dem bin no dey aware of wetin happun until anoda parent wey dia pikin dey go di school call dia attention to di incident. Di woman wey tok say di mata happun for Dubai call on authorities to come help am.

BBC Pidgin try to reach out to Chrisland school to react on di mata but di pesin wey pick di call say dem go issue a statement soon.

Wetin Lagos State Police don tok
Lagos State Police Command don confam say dem don begin Investigations on di Chrisland School mata.

For statement, di police tok-tok pesin, Benjamin Hundeyin say; “Di attention of di Lagos State Police Command don dey drawn to one alleged rape video wey purportedly show students of Chrisland School Lagos, dey go viral on social media.”

“Di Command don begin investigations into di mata with view to establish di identities of di players for di video,

Di true incident for di video, di geographical location of di incident, di alleged threat to life against one student of di school and circumstances surrounding di alleged repeated pregnancy tests conducted on one student without parental consent.

“Di Command dey equally take into cognizance di cybercrime angle to di whole episode and no go hesitate to enlist di support of di Interpol should di need arise.

For one holistic and unbiased investigation, di Command go work with relevant ministries, departments, agencies and non-governmental organizations. Meanwhile, di Lagos State Commissioner of Police, CP Abiodun Alabi, fdc, mnim, psc don promise say due diligence go dey observed to make sure no miscarriage of justice happun.”

About the author

Olivia Wilson
By Olivia Wilson

Categories

Get in touch

Content and images available on this website is supplied by contributors. As such we do not hold or accept liability for the content, views or references used. For any complaints please contact adelinedarrow@gmail.com. Use of this website signifies your agreement to our terms of use. We do our best to ensure that all information on the Website is accurate. If you find any inaccurate information on the Website please us know by sending an email to adelinedarrow@gmail.com and we will correct it, where we agree, as soon as practicable. We do not accept liability for any user-generated or user submitted content – if there are any copyright violations please notify us at adelinedarrow@gmail.com – any media used will be removed providing proof of content ownership can be provided. For any DMCA requests under the digital millennium copyright act
Please contact: adelinedarrow@gmail.com with the subject DMCA Request.