Tinubu video: Why APC presidential candidate post dey cause tok about wia e dey and why e never show face recently

T

Presidential campaign officially start for Nigeria on 28 September 2022 ahead of di 2023 elections wey di kontri dey prepare for.

Di All Progressives Congress, APC party last week bin announce say dem postpone di start of dia campaign sake of dem wan expand di campaign council list to accommodate more stakeholders.

Di Director General for Tinubu/Shettima Presidential Campaign Council, Simon Lalong make di announcement for inside statement on Tuesday 27 September, dis na one day to di official start.

But di party never announce di new date wen dem go begin dia campaign.

But dat announcement na one wey some Nigerians receive wit plenti questions.

Because prior to dat, some tok-tok don dey about wia di party presidential flagbearer Bola Ahmed Tinubu dey.

Even as presidential candidates for di 2023 general elections on Thursday 30 September bin sign peace accord for Abuja, Tinubu no show face. But im running mate Kashim Shettima attend.

Some of di presidential candidates wey show for di event na Labour Party Peter Obi, PDP Atiku Abubakar, NNPP Rabiu Kwankwaso and AAC Omoyele Sowore.

Dis one make more pipo kontinu to ask di kwesion about di whereabout of Oga Bola Tinubu.

Wia Tinubu dey?
For di post oga Tinubu no tok wia im dey but im tok-tok dey say na London im dey wia e dey rest.

One Ayo Ayelabowo, wey bi one of di nominees for di Presidential Campaign Council, for one interview on Arise TV, say oga Tinubu bin decide to travel to di UK so e go get some rest bifo di commencement of campaigns.

Ayelabowo tok say “Asiwaju Bola Ahmed Tinubu dey for London. E no fit rest for Lagos.

“Dem no go let am rest. E dey come to Abuja most of di time, but dem go still no allow im rest”.

E add say, “dis man bin dey work for average of 20 hours each day. So, reasonable pipo bin tink say make e leave di kontri sake of pipo no go let am rest since di campaign dey come soon.”

E also explain say di invitation for di peace accord bin come very late, na im make di last-minute arrangement of Oga Shettima to fill di gap come in place.

APC campagn council tok-tok pesin, Bayo Onanuga for im facebook also tok say oga Tinubu no sick say e dey rest for di UK.Onanuga say, “we still tok today at about 2:00pm, and e bin tell me how im one week retreat never make any difference. E still burn im candle till 4.30 a.m today, e add.

But tori wey dey fly around within di party be say Oga Tinubu fit likely return to Nigeria on 3 October.
Dis no be di first time wey Nigerians go react say dem no see Tinubu for public wen dem expect.

For 2021, e bin get one time wey Tinubu bin dey absent for public space for one long time.

Dat time, plenti-plenti tori don bin fly upandan say im sick and even rumours of death wey im don deny.

But di APC national leader return to di kontri later dat year.

President Muhammadu Buhari including oda VIP’s and goment officials including Lagos state Govnor Sanwo-Olu bin pay di national leader visit for London dat time.

Dat one na sake of di rumour of im death.

Afta im visit on 3, August 2021, Govnor Sanwo-Olu of Lagos State bin follow journalists tok for lagos dat time say di national leader of di All Progressives Congress (APC) dey “hale and hearty” for London, di United Kingdom.

E bin say im deliberately go take im eyes see wetin dey happun so e go assure Nigerians say all dey well with Bola Tinubu.

Bola Tinubu na di presidential candidate of APC. Sabi pipo say di 2023 presidential race na three legeed one between di APC, opposition Peoples Democratic Party, PDP and di Labour Party, LP.

About the author

Olivia Wilson
By Olivia Wilson

Categories

Get in touch

Content and images available on this website is supplied by contributors. As such we do not hold or accept liability for the content, views or references used. For any complaints please contact adelinedarrow@gmail.com. Use of this website signifies your agreement to our terms of use. We do our best to ensure that all information on the Website is accurate. If you find any inaccurate information on the Website please us know by sending an email to adelinedarrow@gmail.com and we will correct it, where we agree, as soon as practicable. We do not accept liability for any user-generated or user submitted content – if there are any copyright violations please notify us at adelinedarrow@gmail.com – any media used will be removed providing proof of content ownership can be provided. For any DMCA requests under the digital millennium copyright act
Please contact: adelinedarrow@gmail.com with the subject DMCA Request.