Why New Zealand wan to dey collect tax for cow belch and piss

W

New Zealand don propose to tax greenhouse emissions wey farm animals dey produce wen dem belch or piss as one method to tackle climate change.

Dis na di world first plan wey go see farmers start to dey pay for agricultural emissions in one way or anoda by 2025.

Di kontri farming industry na im dey make about half of im emissions.

Howeva, farmers don come out to criticise di plan, one lobby group say, e go “comot di guts from small-town New Zealand”.

But some farmers don condemn di plan say e go make many of dem sell up.

Federated Farmers national president Andrew Hoggard say di plan go lead farms to comot so dem go fit plant trees.

Farmers go start to dey sell dia land “so fast you no go hear di dogs barking for di back of di ute (pickup truck) as dem drive comot”, e add.

Some don argue say di plans go fit even increase emissions if food productions waka go to kontris wey no get efficient farming methods.

For 2019, methane for di atmosphere reach record levels wey be two and half times above wetin e be for pre-industrial times.

Prime Minister Jacinda Arden say di money wey dem raise from di tax go go back di agriculture industry to finance new technology, research and incentive payments for farmers.

Dem neva decide di pricing but goment say di farmers go fit cover di money of tax by charging more for di climate-friendly food prices.

About the author

Olivia Wilson
By Olivia Wilson

Categories

Get in touch

Content and images available on this website is supplied by contributors. As such we do not hold or accept liability for the content, views or references used. For any complaints please contact adelinedarrow@gmail.com. Use of this website signifies your agreement to our terms of use. We do our best to ensure that all information on the Website is accurate. If you find any inaccurate information on the Website please us know by sending an email to adelinedarrow@gmail.com and we will correct it, where we agree, as soon as practicable. We do not accept liability for any user-generated or user submitted content – if there are any copyright violations please notify us at adelinedarrow@gmail.com – any media used will be removed providing proof of content ownership can be provided. For any DMCA requests under the digital millennium copyright act
Please contact: adelinedarrow@gmail.com with the subject DMCA Request.