Femi Osibona found dead in collapsed building: Ikoyi 21 storey building developer don die

F

Dem don find Femi Osibona dead bodi for di rubbles of di Ikoyi building collapse.

Oga Osibona na di developer of di 21 storey building for Gerrard road wey fall down scata on Monday inside Lagos.

Di Lagos state Commissioner of Police, Hakeem Odumosu confam am give BBC Pidgin on Thursday evening.

He add join say im dead bodi don dey deposited for Military hospital for Ikoyi.

Some eyewitnesses bin tell BBC say oga Osibona dey inside di tall building wen e collapse on November 1, 2021.

But na on Thursday evening, three days afta na im family and friends dey able to confam di real estate developer dead bodi afta dem comot am from di rubble.

Meanwhile, di Lagos state govnor don declare three days mourning for di state sake of di Ikoyi building collapse.

Babajide Sanwo-Olu say make all flags fly at half-mast for public and private buildings.

Di govnor confam say 32 pipo na im dem don recover dia dead bodies from di rubbles.

But dis number dey different from wetin oda rescue agencies release on top di mata.

Earlier on Thursday di Lagos state chief executive visit survivors of di 21 storey building wey collapse for Ikoyi on Monday.

Babajide Sanwo-Olu say im visit to di hospital na to ensure say dem dey get good medical care.

Gov. Sanwo-Olu also revisit di place wia di 21 storey building fall down on 1st November, 2021.

Sanwo-Olu don also task one probe panel im set up to reveal how di high-rise building crash for Gerrard Road on Monday.

Femi Osibona AKA Femi Fourscore profile
Olufemi Adegoke Osibona and Fourscore Homes Limited suffer huge loss on Monday wen 21 storey building for Gerard road Ikoyi collapse.

Osibona na di Managing Director of Fourscore Homes Limited and di developer of di 21 storey building wey collapse.

For inside one interview wit Thisday, e say Fourscore Homes na member of di NHBRC (National Home Builders Registration Council) for South Africa and Zurich Building Guarantee for Europe, as part of di company presence in di abroad.

Oga Osibona tell Thisday live say im company specialize for di building of choice properties for different parts of di world.

Osibona na di first African developer to develop seven-storey building for United Kingdom.

Di property dem call Fourscore Mansion dey located at 113, Albion Drive London Fields, E8, 4LZ, East London. No be only that, e be di first black developer of African origin to build other projects for UK.

Di company begin im journey into real estate for di United Kingdom before dem get branch for South Africa and later Nigeria.

For 2009, when Brig-General Buba Marwa (rtd) be di Nigerian High Commissioner for South Africa, Fourscore Homes build six luxury units wey dem call Fourscore Mansions for Waterkloof.

Di company real estate business start for Hackney, London in 1997. “I be one of di pipo wey im real estate developments lead to di growth of East London.”

Osibona say before im enta real estate, e sell clothes and shoes for living in London. “I begin sell shoes for July, 1991 afta I finish my HND for di UK, and I later sell suits but I stop for 1998”.

About the author

Olivia Wilson
By Olivia Wilson

Categories

Get in touch

Content and images available on this website is supplied by contributors. As such we do not hold or accept liability for the content, views or references used. For any complaints please contact adelinedarrow@gmail.com. Use of this website signifies your agreement to our terms of use. We do our best to ensure that all information on the Website is accurate. If you find any inaccurate information on the Website please us know by sending an email to adelinedarrow@gmail.com and we will correct it, where we agree, as soon as practicable. We do not accept liability for any user-generated or user submitted content – if there are any copyright violations please notify us at adelinedarrow@gmail.com – any media used will be removed providing proof of content ownership can be provided. For any DMCA requests under the digital millennium copyright act
Please contact: adelinedarrow@gmail.com with the subject DMCA Request.